Play video, “Watch: Trump says suspect in ‘barbaric’ attack on National Guard was Afghan”, Duration 1,0401:04Wetin we call dis Video, Watch: US President Donald Trump tok say di suspected gunman na Afghan national.Article Information
-
- Author, James Chater
- Role,
- 27 November 2025, 10:38 WAT
New Informate 2 hours wey don pass
Di US don suspend processing of all immigration request from Afghans, afta dem identify one Afghan man as suspect wey shoot two National Guard soldiers near White House.
US Citizenship and Immigration Services tok say dem take dis decision until dem review dia “security and vetting protocols”.
Di suspect for Wednesday shooting, wey leave two National Guard members seriously injured, dey said to don enter US from Afghanistan since September 2021.
US President Donald Trump call di attack “act of terror”, and im still add say im go take action to remove foreigners “from any kontri wey no suppose dey here”.
Plenty Afghans tens of thousands enter US under special immigration protection afta di wahala US withdrawal from Afghanistan for 2021 during former President Joe Biden time.
Di Department of Homeland Security mention di suspect for press release as Rahmanullah Lakamal, “one criminal alien from Afghanistan”. One official tell BBC US partner CBS say di man apply for asylum for 2024, and dem grant am earlier dis year.
Dem understand say di 29-year-old enter di kontri under one programme wey dem dey call Operation Allies Welcome.
Trump tok afta di shooting say US “must re-check every single alien wey enter our kontri from Afghanistan during Biden time”.
Joint Task Force DC, wey dey co-ordinate National Guard deployment for US capital, tok say di attack hapun around 14:15 EST (17:15 GMT) on Wednesday near Farragut Square Metro Station.
Di soldiers bin dey do high-visibility patrol for corner of 17th and I streets, one place wey plenty office workers dey go chop lunch.
Metropolitan Police Assistant Chief Jeff Carroll tok say di suspect “just waka come from corner” and “start to shoot immediately”, and e add say di soldiers “fall inside ambush”.
Oda National Guard members wey dey nearby hear gunshot come rush come hold di suspect down till police reach.
Law enforcement source tell CBS say dem shoot di suspect four times.
One eyewitness tell BBC how e hear gunshots, pipo begin run anyhow, dey find wia to hide inside nearby shop.
Anoda witness wey dey inside im motor near metro station show BBC video wey e record as two soldiers lie down for ground wit dia uniforms, medics dey treat dem.
One third person, wey dem believe na di gunman, still dey ground dey receive treatment too.
Afta di attack, US Defence Secretary Pete Hegseth tok say di president don tell am make e send 500 more National Guard members go di American capital.
“Dis one go just make our mind strong more to make sure say we make Washington DC safe and fine,” di Pentagon oga tok.
Right now, nearly 2,200 National Guard soldiers dey inside di city.
Dem be reservist force wey govment fit call to act like military, but dia power no reach to enforce law or arrest person.
Dem deploy di troops for August to fight wetin Trump call “crime wey don dey out of control” for Washington.
Crime rate for di city don reduce small since dem bring di force, and Trump dey give credit to di soldiers wey dey for street.
Oda Democratic-led cities for US don see similar deployment, but some pipo dey challenge am for court, accuse Trump govment of doing pass dia power.
Play video, “Watch: How the shooting of two National Guard members unfolded”, Duration 1,0201:02Wetin we call dis Video, Watch: How di shooting of two National Guard members take happun
Trump don put travel ban for pipo from Afghanistan plus 11 oda kontris earlier dis year.
Afghan pipo wey get Special Immigration Visa wey dem give to pipo wey work wit US military and fear say Taliban fit revenge na some of di few wey dem allow, even wit di strong ban.
Taliban come back to power afta US comot from Afghanistan for 2021.
Trump don also stop one programme wey dey protect thousands of Afghans from deportation.
Di temporary protected status programme bin allow migrants get work permit if US govment believe say dia home kontri no safe sake of war.
Additional report by Tom Bateman

